Dem say see danger o
You no dey see danger o
No go loose your center o
All because of paper o
Dem say see danger o
You no dey see danger o
No go loose your center o, yeah
All because of paper

Uh, uhn
All because you want to live the fagi life
You ready to pay the price, do the sacrifice
You're ready to pay the price, take your mama life
And even you no fit explain this your appetite
You want the Benz, you no wan take the taxify
You wan order gold bottles, ehn, maybe 35

You wan hala private jet things, when you catching flight
And you dey she werey losan
You don dey bark for night
Skeletons in your closet
You murdered to chaw supper
All the wrapes of powder you swallow to pass border

All the person pikin you carry for tight corner
I see you when you collect egunje, Oga Olopa (Oga Olopa)
Dem say you talk say you dey find raba
And so you go and deep your two hands in foul matter
Oga, this one you dey do, e pass armed robber
You turn criminal because you to want chaw dollar

Dem say see danger o
You no dey see danger o
No go loose your center o
All because of paper o
Dem say see danger o
You no dey see danger o
No go loose your center o, yo
All because of paper o

Uh
All because they offered you a little dollar
Na which kind foolish marriage wey you throw your daughter?
Small girl pikin wey her hero still be Dora
Small pikin there wey never suppose to leave the mother
You need to hammer, you need to get the dough, e dey important

You want to chop national cake, you dey pray for contract
Dem give you "Ghana must go," make you change the number
Voting never start, you don dey say your congrats
Why your people no fit hide this long throat?

No go use your dirty hand stain the white for my cloth
Mouth full of jokes, hand full of notes
Oh, I hear your people collect price for some votes
Dem say you talk say you no like suffer
And so you go and deep your two hands in our coughers
Oga, this one you dey do, e pass armed robber
Throway moral because you want chaw dollar, ah

Dem say see danger o
You no dey see danger o
No go loose your center o
All because of paper o
Dem say see danger o
You no dey see danger o
No go loose your center o
All because of paper o

(Chillz made it)

Comments (0)